Bola Tinubu: Timeline of how Nigeria kingmaker become king

Ogbonge events for di political career of di incoming president

For 1 March, Bola Ahmed Tinubu bin dey declared winner of Nigeria presidential election for one of di most competitive polls since di kontri go back to civillian rule for 1999.

Plenti controversy don follow im win and two major opposition candidates don file lawsuits against im victory. But for im supporters, dis election na di result of oga Tinubu political ability and years wey im don dey di forefront of Nigerian politics.

Critics don tok about dia worry wit di health and wealth of man wey don enta im seventies and don accuse di former Lagos govnor of corruption, wey im don deny.

Oga Tinubu go inherit falling economy and very divided kontri but im supporters say e fit use im experience as govnor to fix di wealth of di West African kontri.

Bola Tinubu: Timeline 2023 Bola Tinubu: Timeline 2023 Bola Tinubu: Timeline 2023 Bola Tinubu: Timeline 2023 Bola Tinubu: Timeline 2023 Bola Tinubu: Timeline 2023 Bola Tinubu: Timeline 2023 Bola Tinubu: Timeline 2023 Bola Tinubu: Timeline 2023 Bola Tinubu: Timeline 2023 Bola Tinubu: Timeline 2023 Bola Tinubu: Timeline 2023 Bola Tinubu: Timeline 2023

2023

Oga Tinubu become president afta im win 37% of di votes for di debated presidential elections for 25 February. E get ogbonge work for front as Africa most populous kontri dey face widespread insecurity, high inflation and unemployment. Oga Tinubu don promise to unite di kontri and oversee di economy to bounce back.

Bola Tinubu: Timeline 2022 Bola Tinubu: Timeline 2022 Bola Tinubu: Timeline 2022

2022

Afta months of rumour, oga Tinubu declare say im go run for president. Im campaign face plenti gbas-gbos on top im age, alleged corruption and im running mate choice - a northern Muslim, wey critics tok say go against di trend of mixed faith ticket.

Bola Tinubu: Timeline 2021 Bola Tinubu: Timeline 2021 Bola Tinubu: Timeline 2021

2021

Dapo Apara carry oga Tinubu go court. Apara na accountant and former managing director for Alpha-Beta, wey be company wey dey handle di internally generated revenue for Lagos State. Di former govnor bin dey accused say e use di company take do money laundering, fraud and tax evasion. E dey allegedly hold stakes for di company through one of im padi-padi. Dem settle di mata out of court a year later.

Bola Tinubu: Timeline 2019

2019

Just before di kontri presidential elections, video of bullion van as e dey enta oga Tinubu house for rich part of Lagos go viral, wey cause allegations of vote buying for social media. President Muhammadu Buhari later win re-election for second term.

Bola Tinubu: Timeline 2015

2015

President Buhari dey elected as president wey end di 16-year rule wey di People's Democratic Party bin get. Oga Tinubu go later boast of im contribution wen e dey run for di same office for 2022.

Mr 'Di Lion of Bourdillon' one controversial documentary wey accuse Tinubu of corruption and controlling Lagos State, bin dey broadcast for AIT. E sue di broadcaster for libel and ask for 150 million naira (ova $325,000) in damages and make dem comot di documentary for air. Dem later settle out of court.

Bola Tinubu: Timeline 2013

2013

Di four biggest opposition parties for di kontri collabo to create di All Progressives Congress (APC) so as to challege di PDP for di 2015 elections. Oga Tinubu bin dey part of di negotiations and merger wey support di APC presidential nominee General Muhammadu Buhari.

Bola Tinubu: Timeline 2011

2011

Oga Tinubu face di Code of Conduct Tribunal for di second time but dem clear am.

Bola Tinubu: Timeline 2007 Bola Tinubu: Timeline 2007 Bola Tinubu: Timeline 2007

2007

Oga Tinubu tenure as Govnor of Lagos finish, but dem start to call am 'godfather' and im get accuse say e continue to get strong hand on di state money and also hand pick who go follow am as govnor.

Dem first charge am go di Code of Conduct Tribunal say im allegedly get foreign accounts illegally wen im be govnor. E deny di charges.

Bola Tinubu: Timeline 2003

2003

Tinubu win re-election as Govnor of Lagos. Dem credit am say im grow di state income with foreign investments and supporters say e improve roads and state services. Critics say public infrastructure don spoil and dey point di state light rail project wey start during im reign wey dem neva fully finish afta more than 20 years.

Bola Tinubu: Timeline 1999 Bola Tinubu: Timeline 1999

1999

Nigeria return to democracy. President Olusegun Obasanjo dey elected as president while oga Tinubu win Govnor of Lagos State under di Alliance Democracy party banner. Obasanjo bin don rule Nigeria as miliary head of state from February 1976 to 1979.

Bola Tinubu: Timeline 1998

1998

General Sani Abacha five year rule end wen e die for June. Oga Tinubu come back from exile months later.

Bola Tinubu: Timeline 1994

1994

Many pro-democracy activists and supporters plus oga Tinubu go exile abroad to dodge persecution from military dictator Abacha.

Bola Tinubu: Timeline 1993 Bola Tinubu: Timeline 1993

1993

Nigeria enta kasala wen di 1993 presidential election, wey dey seen as di kontri most free and fair, bin dey anulled by General Ibrahim Babagida. Afta one short takeover goment, General Sani Abacha seize power for military coup and im rule bin dey stained with human rights abuses and corruption. Moshood Abiola, di winner of di election, dey jailed.

Di US Department of Justice file complaint say from early 1988 accounts wey dey opened in di name of Bola Tinubu bin get di money from di sale of white heroin. Di accuse be say oga Tinubu bin work for di main suspect, Abegoyega Akande. Di court confam say dem get reason to believe say di money for di accounts bin dey come from drug trafficking but dem no ccharge Tinubu. Instead im reach compromise and forfeit $460,000.

Bola Tinubu: Timeline 1992

1992

Oga Tinubu political journey bin start as dem elect am as senator wey go represent di Lagos West constituency under di Social Democratic Party. For di National Assembly, e serve as do Chairman of di Senate Committee on Banking, Finance, Appropriation and Currency.

Bola Tinubu: Timeline 1980s

1980s

Oga Tinubu say e work for di US consultancy firm deloitte before e come back to Nigeria wia e work as auditor for Mobil oil.

Bola Tinubu: Timeline 1979 Bola Tinubu: Timeline 1979

1979

Like plenti of im biography, Tinubu academic record bin dey put under plenti investigate for im political campaign but Chicago State University agree say e truly graduate with degree for business administration for 1979.

Bola Tinubu: Timeline 1970s

1970s

Tori about Tinubu early life and education no clear, but e dey widely accepted say e move go America for di mid 1970s.

Bola Tinubu: Timeline 1952

1952

According to one campaign website, dem born Bola Ahmed Tinubu on 29 March, 1952, for Lagos, Nigeria. Plenti opponents say dis claim na lie and e dey older by far.