Di Saraki family political waka
Pikin dem from some ogbonge family for Nigeria don tanda for different political office. Example na Nigeria Senate presido, Bukola Saraki wey be one of di pikin dem for di Saraki family. Afta im loss for di PDP presidential primaries wey dem just do finish, we wan look di ogbonge positions wey members of di Saraki family don enta.
Abubakar Olusola Saraki
(May 1933 - November 2012)
Na doctor wey later join politics, come serve as senator for Nigeria Second Republic (1979- 1983) and na im be di senate leader dat time. E die for 14 November 2012.
Political Waka
-
1977Dem vote am as member of di Constituent Assembly wey produce di 1979 law.
-
1979Dem vote am as senator for di Second Republic
-
1983Dem re-vote am enta inside senate under National Party of Nigeria (NPN).
-
2001Na head of one team from di Arewa Consultative Forum wey be culture and politics group from North, wey dem send go meet and tok wit Northern govnors and oda leader for evri-everi to dey ok.
-
2003E support im son, Bukola Saraki to contest for Kwara state govnor position.
-
2003E support im daughter, Gemisola Saraki to contest for senate wey go represent Kwara State Central.

Abubakar Bukola Saraki
(December 1962 till now)
E be Medical Doctor. E be di pikin of Nigerian politician, Olusola Saraki wey don die. E later join politics and come be di govnor for Kwara state for 2003.
Political Waka
-
2003Dem vote am as Govnor for Kwara state
-
2007Dem re-vote am as Govnor for Kwara state
-
2011Dem vote am enta senate under the People's Democratic Party (PDP), to represent Kwara Central senatorial district.
-
2015Dem re-vote am enta senate under All Progressive Congress (APC)
-
9 JuneE become presido of di Senate 8th Assembly.
-
31 JulyE run go join People's Democratic Party (PDP)
-
30 AugustE announce im plan to contest for 2019 presidential election
-
6 OctoberE loss PDP presidential ticket to Atiku Abubakar.
Gbemisola Ruqayyah Saraki
(May 1965 - till now)
She be Economist and Insurance pesin. She be di younger sisiter to Senate President, Bukola Saraki and pikin to late Senator Bukola Saraki, wey be Senate leader for di Second Republic.
Political Waka
-
1999Dem vote am enta House of Representative to represent Asa/Ilorin West Federal Constituency, Kwara State.
-
2003-2011Na Senator wey dey represent Kwara Central Senatorial district under People's Democratic Party (PDP).
-
2015Loss di govnor ticket for Kwara State under PDP.
-
7 Aprilleave PDP go join All Progressive Congress (APC)
-
2016President Muhammadu Buhari put am as pro Chancellor and Chairpesin for Federal University Otuoke, Bayelsa State.
-
2018E announce say im support president Buhari plan to contest for 2019 presidential election.
Who get di foto dem
Getty Images, Facebook