Tok-tok Click to tok

image
Moshood Olalekan Adeoti
Action Democratic Party (ADP)
Wen dem born am
Work e dey do
Di gist
  • Dem born Moshood Olalekan Adeoti for Iwo, Iwo local goment area of Osun State for 27 February 1953.
  • Im start im primary school education for District Council Primary School for 1959 and Aipate Baptist Day School for 1964. Im finish for 1974.
  • Im graduate from University of Benin wia im study Bizness Admin for 1984.
  • E become state chairmo of Alliance for Democracy party from 1998-2003, state chairmo of Action Congress from 2006-2010, state chairmo of Action Congress of Nigeria from 2010-2011.
image
Isiaka Oyetola
All Progressives Congress (APC)
Wen dem born am
Work e dey do
Di gist
  • Dem born Isiaka Oyetola for Iragbiji ni Boripe local goment area for Osun State.
  • Oyetola follow for those wey start Allaince for Democracy party (AD) and begin life as politician for 1997.
  • Even though im don be politician for 20 years, dis na di first time e dey run for office.
  • Some pipo believe say im be paddy-paddy to Govnor Rauf Aregbesola and APC national chairmo, Ahmed Tinubu.
image
Alhaji Fatai Akinbade
African Democratic Congress (ADC)
Wen dem born am
Work e dey do
Di gist
  • E join Osun state civil service wia im work for 16 years under three military administrators and civilian gorment of Olagunsoye Oyinlola. African Democratic Congress (ADC)
  • For 2003, dem appoint am as Secretary to di State Goment of Oyinlola.
  • For 2010, e announce say im wan join 14 odas contest for govnor seat inside Osun State but dem reject am.
  • Akinbade later come be di candidate for ADC inside dis election, two weeks afta e comot PDP.
image
Ademola Adeleke
People's Democratic Party (PDP)
Wen dem born am
13th May, 1960
Work e dey do
Di gist
  • Dem born am 13th May, 1960 for Enugu inside di family of Senator Raji Ayoola and Nnena Esther Adeleke from Ede
  • E begin school wit Methodist Primary school for Surulere Lagos and Nuwarudeen primary school Ikire, e go Seventh Day Adventist and Muslim Grammar School Ede, and also study Criminology for Jacksonville State University Alabama USA
  • E be di Group Executive Director for Pacific Holdings Limited from 2001 to 2016 and Quicksilver Courier Company for Atlanta, Georgia 1985 to 1989
  • E begin im political waka for 2007, become senator to represent Osun west senatorial district afta im broda, Senator Isiaka Adetunji Adeleke wey be di first civilian Govnor of Osun state die.
image
Senator Iyiola Omisore
Social Democratic Party (SDP)
Wen dem born am
Work e dey do
Di gist
  • Dem born Iyiola Omisore was born for di old town of Ife inside Osun State for September 15, 1957.
  • E be di Osun State Deputy Govnor to Bisi Akande between 1999-2003.
  • Dem vote Omisore as Senator to represent Osun East under Peoples Democratic Party, PDP, between 2003-2014.
  • E contest for govnor seat inside di state for 2014, but Govnor Rauf Aregbesola win am.
Meet di candidates
image
Di gist